Jump to content

Wikipedia Pej dem Wey Nid Foto 2025

From Meta, a Wikimedia project coordination wiki
This page is a translated version of the page Wikipedia Pages Wanting Photos 2025 and the translation is 77% complete.
Outdated translations are marked like this.

Wikipedia Pages Wanting Photos 2025

Home Participating Communities Organizing Team Participate Results Resources FAQ & Campaign Rules
Abeg no put foto for langwej wey yu no sabi. No add foto wey no get beta kapshon. For yor edit summary, tok wetin yu chenj and add dis hashtag: #WPWP.

Wikipedia Pej dem Wey Nid Foto (WPWP) na kampen wey dey hapun evri yia for Wikipedia for difren langwej. Di aim na to add beta fotos for Wikipedia atikul wey no get foto bifor. Dis one go help pipul sabi yuz all di fotos wey dem don kolet from Wikimedia foto kompetishon an foto wok wey Wikimedia komuniti oganaiz. E go also mek Wikipedia swit and izi to rid, show wetin di atikul dey tok, and mek di pej fine.

Plenti fotos dey Wikimedia Commons. Pipul don upload dem from foto wok, kontest, and oda program like: Wiki Loves Monuments, Wiki Loves Africa, Wiki Loves Earth, Wiki Loves Folklore, etc. Bot na onli smol smol of di fotos dem dey yuz for Wikipedia atikuls. Today, di Wikimedia Commons dey kip millions of foto bot na onli smol foto of dis foto dem wey dem don yuz for Wikipedia atikul pages. Dis projet dey trai mek sure say dem no waste, so dem dey enkorej pipul to yuz dem wel.

Hau yu fit join

Bifor yu stat, mek shwo say yu rid all di steps an ruls. If yu no folow am, dem fit diskwolifai yu.

  1. Check whether you're eligible. Eligibility rules were revised in the 2023 edition and participants are required to have a User account that's at least a year old to be able to participate. Sign in if you are already registered on any Wikimedia project. The list of all languages of Wikipedia can be found here: one account can be used on all different language versions.
  2. Find one atikul wey nid foto. E get plenti ways to find am. Yu fit trai dis.
  3. Search Commons for gud foto. Yuz korekt taitul or katigori to Search for the imej. E get plenty way to du am. Chek dis simple media reuse gaid if yu nid help. Na more advais to folo bi dis. Mek shor say di foto go help esplein wetin di atikul dey tok – laik pipul, ples, idea or akshon. No put foto just to dekoret pej. Mek shor say di foto rili help.
  4. For di artikul: Find wie di foto go help. Klik “Chenj-am”, add di foto. Rait short kapshon wey tok wetin di foto dey show. Yuz klia an gud kwoliti foto. No yuz dak or foto wey no tu klia unless yu no get chois. Always rait short edit summary. Klik “Sho am as e go bi” to chek. Put #WPWP for di summary, den klik “Poblish chenj-dem”. Abeg si: Guide on how to use WPWP Campaign Hashtags
  5. Abeg, shine yor eye for hau to add imej! For infobox, e izi wel-wel — just rail the imej nem. No do [[File:Obamas at church on Inauguration Day 2013.jpg|thumb|The Obamas worship at [[African Methodist Episcopal Church]] in Washington, D.C., January 2013]], just yuz The Obamas at church on Inauguration Day 2013.jpg.

Hau to rait file nems and kapshons for koret way

One white dog wey wie strap dey play wit one smol boi
Siberian Husky wey dem dey yuz kari load

Simpul ezampul (di imej go show for rait side):
[[File:Siberian Husky pho.jpg|thumb|alt=One white dog wey wie strap dey play wit one smol boi |Siberian Husky wey dem dey yuz kari load]]

  • File:Siberian Husky pho.jpg Di file (imej) nem gatz koret wel (mek e get di same kapital leta, mark, and space) and e gatz get .jpg, .png or eni oda extension. (Imej: and File: go wok for di same way.) If Wikipedia and Wikimedia Commons get foto with dat nem, di one from Wikipedia go show for di atikul.
  • For most times, yu go nid to add thumb
  • alt=One white dog wey wie strap dey play wit one smol boi Alt text na short tori for pipul wey no fit si di imej. E dey show wetin di imej luk like, e no bi like kapshon. Folo accessibility guidelines and add big nems, events, or tins if dem dey inside.
  • Siberian Husky wey dem dey yuz kari load Di kapshon dey kom last, and e dey tel di rizin or minin of di imej.

Chek en:WP:Extended image syntax for more tins wey yu fit do wit imej. If di imej no show afta yu don chek di syntax wel, e fit bi say dem blok am.

  • For contributors to Wikidata, join the dashboard to allow your contributions be tracked. See the Outreach Dashboard

Ruls for di kampen

Na bitwin 1 July to 31 August 2025 wey pipul must put foto for Wikipedia atikul dem.

Yu fit add as meni fotos as yu wan.No limit for hau meni foto yu fit yuz. Bot prize dem dey for difrent katigori (si down). No go spoil Wikipedia atikul wit foto. Onli put foto for atikul wey no get foto bifor.

Di foto must get fri-yuz laisens or mek e dey for poblik space. Di kain laisens wey yu fit yuz na: CC-BY-SA, CC-BY, and CC0

Yu gats get akaunt for eni Wikimedia projet to join. Enta insaid or opun niu akaunt for Wikipedia. Yu fit mek akaunt for eni langwej vashon of Wikipedia, and yuz am for yor own Wikipedia plus all Wikimedia sites. Yu fit si all the langwej demhie.

Wi no go kolet foto wey poor or wey no klia.

  1. Di kapshon and hau dem tek tok abaut di foto must dey klia and mek sens for di atikul.
  2. Eni foto wey yu add must get kapshon wey tok wetin dey inside di foto.
  3. Eni foto wey yu add to atikul must get kapshon wey tok wetin dey inside di foto.
  4. No add foto for atikul wey yu no sabi wel wel. Pipul wey dey add foto witout kapshon or wey dey put foto wey no relate fit komot for di kontest.

Enibodi wey dey join must put di hashtag #WPWP inside the Edit summary enitaim dem add imej to atikul, plos smol diskripshon of wetin yu do. Ezampul: I add imej of elephant for dis atikul #WPWP. No go put di hashtag (#WPWP) inside di atikul bodi. Chek dis guide: Guide on how to use WPWP Campaign Hashtags.

Hau yu go tek join for #WPWP?

Dis part na to mach hau yu wan tek join for WPWP. Clik di botins wey dey down to si di difrent way wey yu fit join.

Time Plan for Evribodi

  1. Stat date: July 1, 2025
  2. End date: August 31, 2025
  3. Rizolt date: October 10, 2025

Prize Katigoris for Evribodi

  1. Top Kontri Kontributo – Dis one na for di kontri wey do di most wok or get di bigest impact.; Wikimedia Nigeria UserGroup
  2. Best Organaiz Komuniti Kampen: For lokal tim wey organaiz wel, do beta outreach and events.; PhilWiki Community
  3. Best for Smol Langwej – For pipul wey dey add koret, gud-kapshon foto wey klia wel for smol langwej Wikipedia.; Derk29
  4. Top kontributo to Wikidata: For pipul wey dey add koret, gud-kapshon, klia foto to Wikidata.
  5. Top kontributo to Wikipedia: For pipul wey dey add koret, gud-kapshon, klia foto to Wikipedia.; Nikolina Šepić
  6. Top contributor to Wikipedia (audio): For a user contributing highly relevant, well-captioned, high-resolution audios to Wikipedia; Sumita Roy Dutta
  7. Top contributor to Wikipedia (video): For a user contributing highly relevant, well-captioned, high-resolution videos to Wikipedia; Goutam1962
  8. Best New Pesin (pipul wey join for July 2025): For pipul wey put beta, klia foto wit gud kapshon for Wikipedia or Wikidata. Invalid category: New editors were not eligible
  9. Speshal Tank Yu: For pipul wey don dey help add beta foto to Wikipedia sins 2020 for dis kampen; Goutam1962
  10. Women and LGBT+ Contributor special award: For a user contributing highly relevant, well-captioned, high-resolution images to women and LGBT+ related articles; Goutam1962. For this category, add #WLGBT as part of your edit summary. Contributions not tracked with #WLGBT would not be considered.